Episode 8
I was restless, I began to sweat, I shower, I wan sleep I no fit.. I check my Kush stash make I roll something, as d tin sabi cool me down, chai my stash was empty.. which kind show be this I check time na 2: 34pm, time still dey before my popsi n momsi dem come back.. so I bust out.
I reach one of my niggers em place, we come comot be4 I know watsup we don complete… na so I come gist dem whatsup.. but I come Lie say I don beat the Nene wella, why she go dey slap me.. say I no need the girl again..
Some of my niggers hail me say I do well say y I go d allow girl dey carry me play.. One of them come talk say, say I Bleep up! Say dat girl no b my mate, and she too fine say I suppose d treat am like queen, say normally no b person like me suppose dey date am.. and moreover a relationship with a girl of her class was expensive and me am gettin it for free…say na total Bleep ups me do so…
Ouch those words sank deep into me, I just remembered how beautiful this girl was, I drew in my weed but my kush began working oppositely the only thing I was seeing was that of Nene … I took in again it was now the video playback of our shakespare moments. .. for once my Kush failed me I decided to leave niggers and to hit home…
As I leave my niggers I decided to board a bus instead of using motor bike to save me a lil money as I was now left with only four hundred box in my wallet. 4 inside bus na so one guy do like say him wan call person outside the bus the halla Margret! Margret ! D press me.
Na so me vex chance this guy.. He apologised and said I should not get angry say e don tay him no see dat girl na so him comot from the bus…
The bus don nearly full as d conductor begin the ask for money na so I put hand for pocket I realised my wallet was gone.. that guy bin don comot my wallet. Na so I begin do explaination give conductor but na meanigless as d guy ask me say how him go do now? I no fit ansewr that question, na so I step down
Lying on my bed so tired as I come d Imagine children of Isreal trekking for 40years in the wilderness I pity them… cos no beans.
As I remember the trekking wey me trek today I come d vex.. I decided I should go and collect d handbag wey I buy give Nene after all na she cos all this misfortune, she doesnt deserve anything good from me……as I stand up from bed make I go her room go collect d handbag na so my mumsy hala me say I get call
Me: hello
Ella: hey dear whatsup?
Me: fine n u? As I smile wey be say I don forget as person d take smile…. we had a brief conversation she told me she ll b comming in tomorrow say she dey touch down by 1: 30pm .. I promised to call her moro.. and that I could not wait to see her on monday in school….
[ads4]
After the call I come borrow posture from those people wey dey stand for cabin biscuit… as I come d smile..
I enter my room begin look for my best cloth.. I put am on top Ironing board..
To Be Continued
Choose Episodes Below;
Note: episodes already read are highlighted in red!
Episode 1 Episode 2 Episode 3 Episode 4 Episode 5 Episode 6 Episode 7 Episode 8 Episode 9 Episode 10 Episode 11 Episode 12 Episode 13 Episode 14 Episode 15 Episode 16 Episode 17 Episode 18 Episode 19 Episode 20 Episode 21 Episode 22 Episode 23 Episode 24 Episode 25 Episode 26 Episode 27 Episode 28 Episode 29 Episode 30 Episode 31 Episode 32 Episode 33 Episode 34 Episode 35 Episode 36 Episode 37 Episode 38 Episode 39 Episode 40 Episode 41 Episode 42 Episode 43 Episode 44 Episode 45 Episode 46 Episode 47 Episode 48 Episode 49 Episode 50 Episode 51 Episode 52 Episode 53 Episode 54
Leave a Reply