Episode 21

Well i wasnt that surprise to see her,
honestly i saw glimpse of it, but i need to
know what she is and i need to hear it
from her mouth, in order to reduce my
thinking i order for one bott’e of star
even though i nor dey drink before, but
this time i need something more than
hot, and since i dey the right place i just
cucuma start drinking without thinking.

Guy 1: chelsea go beat man utd

Guy 2: go sit down who know chelsea.

Guy 3: guy forget that thing oh you
know say we get costa now.

Guy 2: forget about costa phil jones go
pocket am.

Guy 3: haahaha who know phil jones,
even though self e fit pocket pocket
costa what of fabregas?

Guy 2: fabregas wey dey lost for match,
nobody go pocket am e go pocket
himself.

Guy 5: man united na only talk una sabi
talk, no bi small arsenal beat una for F.A
cup and na una welbeck even score the
winning goal,

Guy 2: forget that one, arsenal no fit beat
us again, we just dash them welbeck
because im leg na biscuit, na so so injury
im dey injure.

Guy 1: guy shotup you too get mouth
after we beat una finish na, you go keep
quiet like mumu.

Guy 2: thunder fire that na head wey be
like were train dey pass go london for
calling me mumu.

Guy 3: thunder fire your papa if na
cause.

Guy 2: guy na me you dey talk to, look
me well oh i resemble your mate,
because of say i sit down here with you
you come get mind to dey yarn for were
big bros like me dey talk.

Guy 1: abeg shot up for there, wether
you be old man or not, so far me and
you dey here together we be mate.

Guy 2. If you nor shot up for there na i
go para this bottle for your head, you
dey mad you know who i be

Guy 1: guy u nor fit do more than a dead
rat, do your worse (standing up and
pulling his shirt, ready for fight) the
other guy took star bottle and throw it at
the other guy, the bros bend down and
dodge it, the bottle flew and smash the
back of my head, i didnt even feel any
pain at all, no injury nothing at all, after i
check the back of my head i see say no
blood, no scratch and no sign of injury, i
stood up and ask.

Me: na who be the person wey throw
that bottle.
(before i they talk finish the bar don
empty)

Well i dont know what happened but i
know Adanna play a role in it, not
withstanding i finish my drink, called the
barman from inside and pay my bill.

Barman: were everybody dissapear go?

Me: am i their keeper?

Lol the guy dey craze, why im wan para
for my head na, i left the place by 7:45 i
took my phone and started chatting with
my friends in school, we gist about alot
of things, and i still dey road, i continue
chatting and laughing like a madman,
you know sometimes, the light of your
phone will dim your eye that you wont
know where you are going again, na so i
dey chat dey go then kpooarr i fall inside
gutter and injure my leg i wonder why
adanna no protect me this time,
person wey dey follow me for back
begin laugh like say na basketmouth
show im dey, well i nor blame am.

I reach my house around 7:50 i enter my
room jejeje i lock my door, i remove the
chain and hang it on the wall i remove
my clothes remaining only boxer and
singlet, i lay down on my bed, thinking
over the whole issue, well i dont know
how we started but i know how we will
end, is either we marry each other or we
both die, i smile as i think about her, i
will proudly take her to my mum and
show her the beautiful angel i will marry,
and no body, i repeat nobody will stop
me from marrying the girl of my dream, i
continue thinking about her and my joy
continue rising, the thing is that am not
myself anymore, her smile, her lips and
her breath infact everything about her
brings me closer to her, when i
remember how she smile when she look
at me on the road, oboy my head wan
scatter, but wait oh, why was she at the
middle and why was she the only with a
crown, well i guess i have to wait for her
to get those answers, i was lost in my
thought when a test enter my phone.
“you brought your witch girlfriend to kill
my boyfriend and his friend abi, dont
worry i will show you pepper and i will
tell you that we owns this aba, if you
dont know, my father was part of the
men that terrorise aba in 2005 and
2006, i still have contact with all his
friend and am going to show you
pepper that you will run back to that
your Bleeping edo state.”

i dont need to ask who sent me that
message now do i?


You May Also Like 🔥


Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*