Read Story: SEASON 1 EPISODE 14

Any of una wey dey read this story wey don call me

before go understand say na so I dey take tell

person say I no get him number. Sometimes self, na

forget I dey always forget to save the number.

“It’s Hannah”

The next question wey suppose comot from my

mouth na “which of the Hannahs” but I dey craze? Na

so my former babe carry break up with me because

I mistakenly ask her, which of the Lindas.

“Hannah…. uhmm…..”

Just to but time.

“You gave me your card yesterday. We met in the

bus.”

Bingo, no Bruno, no Lucky, no Tiger!!!

“Yeah, I remember.”

“I tried your number a couple of times yesterday but

it wasn’t going through.”

She said, her voice dey sound like say she wan cry.

“I am sorry about that. There was no light to charge

my phone and my generator had fault”

Now, that is one big lie. Una no fit blame me na, you

have to do the do to get the pucci.

“Uhm…. Can I come?”

Chineke, the babe was leading me o. Naturally, my

diicckk kicked in and it replied instead of my mouth.

“Okay. Meet me at Oceanic Bakery. Do you know

there?”

I asked abi, my dicckk asked.

“Double-pole right?”

She asked back. Typical Naija girl. SHe even don

waka reach that ends self.

“Yes.”

I replied, I just dey pray make no be July f00l she

wan run for my head.

“Expect me in the next 15 minutes.”

She said and cut the call. Na which house self she

wan come? My sister place? For where. I quickly pull

my clothes, where white sleeveless, three-quarter

and palm-sandals. I look my brother, him still dey

watch film. I for like carry the guy join body but

men, this babe fit need something else o. I no forget

to carry my wallet sha. I pick my phone, dial my

friend wey him house dey closer to double pole.

Toto can really change the world. Me wey dey fear

double-pole wan attempt the place in the night.

What can toto not do?

“Gordon-kpokorrrrr!!!”

I hala the guy.

“Foxy-B in the building.”

No ask me o. Na my stage name be that.

“You dey your crib?”

“Yes, you dey come.”

“Big time. E get one game wey I wan run for there.”

I answered him.

“Oya na, I dey wait. Do sharp sharp come as I wan

comot self.”

Bingo!!! I pray make the parole make sense

ooooooo.


You May Also Like 🔥


1 Comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*