Read Story: SEASON 1 EPISODE 17
As i leave for karasco i branch buy some drinks make i use am against ma favourite
as i reach auz grammy talk say make i go carry ma food for kitchen
wen i enter kitch i see ma food well covered,i carry am go ma room.as i land for bed i quickly battle with d food like say we dey do competition base on say na once in a while i dey chop am
after i finish d food i com press am down with d drinks
i rest for a while b4 i test those clothes i go check maself for mirror tho i no get money but wen girls see ehn saliva go dey drop for their mouth
oboi see as u set their fada we go burst dat bar today with karasco
at d bar na #10000 i plan o using #8000 make i keep d remaining,so i told karasco make he order wisely cuz i know who him be
i order for power horse and pepper soup while karasco order for macdowell and pepper soup
mrdan:i go treat dis guy fk if him ordero
CI still dey think wen i hear karasco talk say make dem give am simnoff and pepper soup
mrdan:i tink it high time i disgrace dis guy me wey get money gan i no ordaer too muchehn karasco i won go pee
karasco:ohk no tey o
i went to d
mrdan:how much be my money
barman:ur own na #2000 bt ur friend own na #4000
i gave d barman #6000 for me and half for karasco so him punishment no go too much,i sneak out of d bar
i went home to siddan for under d mango tree dey reason
mrdan:abi make i tell sandra make she send me some moneys to open a car wash along d express
i pick ma fone call her num she pick am,i tell her all ma plans at 1st she no won gree bt after much convincement she later bt i should plan how much i go need
i jump tell grappy say i dey come
i went to d express to look for where suitable,i later found one and i make enquires about who get d land dem tell me him auz
i went to his auz tenk god say i met am for auz
we talk sotey b4 we later agree on #250000.i later went home to do ma budget
Choose Episodes Below;
Note: episodes already read are highlighted in red!
Episode 1 Episode 2 Episode 3 Episode 4 Episode 5 Episode 6 Episode 7 Episode 8 Episode 9 Episode 10 Episode 11 Episode 12 Episode 13 Episode 14 Episode 15 Episode 16 Episode 17 Episode 18 Episode 19 Episode 20 Episode 21 Episode 22 Episode 23 Episode 24 Episode 25 Episode 26 Episode 27 Episode 28 Episode 29 Episode 30
Leave a Reply