Read Story: SEASON 1 EPISODE 6

I waka go kitchen go carry ma food na im grappy dey tongue lash watin concern me i sha know say i go chop d food.afta finish eatin i went to ma room go sleep

d next day around 6am grappy com wake me say make we go farm nd me as i dey so i no like to farm nd na still midnite d sleep dey sweet me so i quick forge lie

mrdan:grappy i no well

grappy:….(went out)

i dey enjoy ma sleep b4 i hear d voice of grappy

grappy:(shouting)today ehn i must behead dis bastard everytime i say make we go farm he go say him no feel fine bt he sabi

i neva let grappy enta ma room b4 i fly out through window. if u see d kin run wey i run ehn even usain bolt go dey fear me

mrdan:(panting)so dis man won kill me sha me wey still get many p—y to destroy i know watin i go do 4 ram

i went to ma friend place karasco

karasco:ah oboi y i see u dis elimomo

mrdan:i run commot auz cuz of ma grappy o

karasco:watin u do am

mrdan:he talk say make we go farm i no gree he won com cut ma head pakam

karasco:so watin u won do now


You May Also Like 🔥


Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*